Me: Itz bn a whyl o...o'l boy aw far?
Blog: I dey o...i dey as u leave me...
Me: How kwanu i take leave u...
Blog: Since January...abi u don 4get???
Me: Nooooo...i no 4get jes bn bizi...
Blog: Yes na...Busy with twitter and doz girls
Me: How?...na work jor
Blog: Yimu...u don forget say i dey follow u abi?
Me: How???...u dey follow too?
Blog: U must b silly...i am online 24/7...u jes dey come dey go...wetin u knw???
Me: Oya sowie...
Blog: No sowie mi o...u and dat lawyer go jes dey do anyhow abi?
Me: Choi...u rili dey follow mi tru tru...
Blog: No I no go follow u...
Me: But omo dat gal dey giv mi serious headache...
Blog: Go buy paracetamol na...
Me: I don try...e don tire mi...but i luv am well well...
Blog: *whistles*
Me: Why u dey whistle na?
Blog: E cosign u?...see kweshun ooo...
Me: My frnd talk...
Blog: #edondeymadt abi?
Me: Oya na sori...wetin na?
Blog: Na so u go dey luff...wen dem wan dump u dem no go put u for dustbin...
Me: Wia dem con dey put mi kwanu?
Blog: For river...bcos na fishermen dey always help u c am bring am bck...
Me: U no well...
Blog: I knw...iRiver
Me: Mtcsheeeeeew
Blog: Wetin com even cari u com hia today...
Me: I no knw o...i jes com c how u dey...whether u don die...
Blog: Taaah...abi na anoda pesin blog make u com service me...
Me: Na wa o...u don knw mi finish...
Blog: b4 nko?...oya who is she?
Me: "she" ke?...y must it b she???????
Blog: Answer ke...
Me: Na wa u o...ok na she...
Blog: Spill it...
Me: Elceedutchess
Blog: Dat one wey say im like Fcuk???
Me: Ahn Ahn...aw u take knw???
Blog: Jamb Kweshun...shebi u no knw say na mi b blogger?
Me: Sowie
Blog: She fine sha....get fyn eye...eye lyk winch
Me: Ol' boy izzi...thank God u no b human u for b serious woman wrapper...
Blog: Naice insult...thank God I am ur blog...so we share same traits...
Me: U dey madt...
Blog: I wish u d same...
Me: Mtcsheeeew...i dey come...
Blog: I'v hrd dat so many tymes... *hope u dont stay longer*
Me: I'm serious...
Blog: I knw...
Me: later man...
Blog: Bye bye jor...
Me: I dey come...
Blog: Publish and gerrout!!!!!...nincompoop
No comments:
Post a Comment